Chelsea win streak don end as dem chop serious shock 2-1 loss for hand of Sunderland inside Premier League clash wey happen for Stamford Bridge on Saturday.
Alejandro Garnacho open im Chelsea goal account as e score di first goal for di match, after e find small space slot di ball go through di leg of Sunderland keeper Robin Roefs.
But di joy no last, as Sunderland equalize for 22nd minute through Wilson Isidor. And just when everybody don reason say e go end draw, Chemsdine Talbi burst Stamford Bridge silence with one late-late goal wey give di Black Cats big win of di season.
Di result mean say Chelsea don drop to 7th position for Premier League table, five points behind Arsenal wey dey top. Meanwhile, Sunderland don climb go second — no be small matter for newly promoted team.
TPB Verdict
This kind match just show say Chelsea never ready to truly chase Premier League title, even though dem don dey show small small progress for dis 2025/26 season.
After dem score first, dem suppose don seal am. But Sunderland deserve all di respect — di Black Cats show courage, organization and serious spirit wey prove say dem belong for Premier League.

Regis Le Bris and im boys don shock everybody this season — from newly promoted side to second position for table. Dem buy well during summer, and now di result dey show.
Chelsea go need reset fast after this, as di defeat don end dem four-match winning run. This one na dem third league loss this season — e no sweet, but na reality check wey dem need.
Chelsea vs Sunderland Highlights
Alejandro Garnacho Goal (4th min – Chelsea 1-0 Sunderland)
Chelsea start hot. Garnacho smash di ball between Sunderland keeper leg after nice assist from Pedro Neto. Na im first goal for di club and e sweet well well.
Wilson Isidor Goal (22nd min – Chelsea 1-1 Sunderland)
Sunderland equalize sharp sharp as Chelsea defense sleep. Long throw enter box, confusion happen, and Isidor flick am go net from close range. Stamford Bridge quiet small that moment.

Chemsdine Talbi Goal (93rd min – Chelsea 1-2 Sunderland)
Mad scenes for extra time! Sunderland turn di match upside down as Talbi calmly find bottom corner after Brian Brobbey hold play smartly. Chelsea fans weak, Sunderland dey celebrate like say dem win trophy.
Man of the Match – Wilson Isidor
Wilson Isidor no just score equalizer, im disturb Chelsea backline from start to finish. Di 25-year-old forward get three shots and win two aerial duels. Im full performance make am di clear man of di match. But make we still hail keeper Robin Roefs wey make key saves too.
Match Stats
Possession: Chelsea 69% – 31% Sunderland
Shots: Chelsea 16 – 10 Sunderland
Shots on Target: Chelsea 7 – 4 Sunderland
Corners: Chelsea 9 – 1 Sunderland
Fouls: Chelsea 15 – 13 Sunderland
What Next?
Chelsea go turn focus now to EFL Cup as dem prepare face Wolverhampton Wanderers on Wednesday night for fourth round before dem return to league duty against Tottenham Hotspur next weekend.
Sunderland on di other hand go continue their Premier League campaign at home to Everton on November 3.
Live Update Notice
This page go dey updated steady as new info and post-match gist drop. Na live coverage zone, so make you dey refresh from time to time to catch di latest updates from The Pidgin Blog.
