Wahala dey boil for transfer market as Liverpool don finally table offer to carry Victor Osimhen come Anfield – but Napoli just bone like say dem no even see am. Dem reject Liverpool first proposal wey dey involve Chiesa, Nunez and small change on top.
According to new reports, Napoli and Liverpool don dey knack serious gist on top this matter, but e still be like say na only Napoli dey shout “No Discount o!” Liverpool wan do player exchange, Napoli say, “For where? Bring full money join!”
Osimhen to Anfield? Tori dey hot!
Osimhen wey don get only one year remain for him contract, dey very free to waka comot Napoli this summer. And Liverpool don already dey dream say the Naija goal machine go be their next big signing after dem don splash over £190m this transfer window!
The club don already sign:
- Giorgi Mamardashvili
- Jeremie Frimpong
- Armin Pecsi
- Florian Wirtz
- Milos Kerkez (announcement just remain)
And dem still never taya! Their eye don reach Victor Osimhen now – as dem never still get proper No.9 for that Klopp-to-Slot transition.
Liverpool First Offer – Napoli Bone!
So Liverpool reason say, “Okay, make we use Darwin Nunez + Federico Chiesa + small 20 million Euro balance swap Osimhen.” Napoli president, De Laurentiis just laugh – the man no gree. He say Osimhen na full €75 million or nothing. No price slash. No equal swap.
According to De Maggio wey yarn with Radio Goal, Napoli no dey hear that kind ‘equal exchange’ talk. He say:
“Napoli dey firm. No discount. Osimhen get clause and Liverpool go pay am finish. Dem offer Chiesa and Nunez, but Napoli president say abeg add €20m join.”
Wahala for who no wan pay full price o.
Multiple Deals on Ground
Reports still dey fly say if e be say all the players involved no enter the same package, dem go do am as three separate deals.
So far:
- Nunez don gree personal terms with Napoli – e remain paper work.
- Napoli still dey drag Chiesa and dey use style eye Noa Lang and Dan Ndoye join.
- Osimhen still dey wait the green light – but e clear say Napoli go sell if money correct.
So Wetin Be The Final Say?
Liverpool get money. Osimhen dey available. Napoli wan sell. But the problem na say nobody wan lose for the deal. Liverpool dey play sense, Napoli dey play agidi.
But one thing sure – this matter never finish. Expect more drama, twists and gbas gbos before anybody hold that Osimhen jersey for Anfield.
Make we dey watch – this tori still dey hot like jollof inside microwave!
Follow TPB for more football tori wey dey burst brain. Na here cruise and sport gist dey jam like Owerri traffic on a Friday.