Omo! Another twist don show face for Manchester United transfer gist as dem dey eye Dominic Calvert-Lewin like hot Agege bread – and e go shock you how.
Di 28-year-old striker don waka comot from Everton after nine whole years. Na free agent e be now, and United wan use that opportunity do “sharp guy” move wey no go break bank.
Calvert-Lewin Free, But No Be Free-Free
According to The Sun, new Man United coach Ruben Amorim dey seriously ginger make dem sign Calvert-Lewin on a free transfer. Na wetin e like be that.

But hold up — e no mean say United go just grab am anyhow. Dem don yarn say dem ready give am plenty signing bonus and correct contract… but baba go be third or fourth choice striker.
Yes o! Calvert-Lewin no go dey lead the attack like Hojlund or Zirkzee. E go just dey bench dey chill, dey wait make match don hot before dem throw am enter field.
Injury Wahala Still Dey
If you dey wonder why people dey look am one kind, na because Calvert-Lewin na injury merchant. Last season alone, e play just 26 matches and score 3 goals. For total career, e don miss 111 matches because of injury or sickness. Ehn ehn. Na the real hospital pass striker be this.

But United still believe say if dem no over-use am, maybe e go stay fit and still deliver goals when dem need am.
No Be Only United Dey Look Am
Make you no forget, Fulham sef dey show interest. Dem dey eye am, say make dem sign am free of charge.
United know say if dem end this summer with only Calvert-Lewin join body, fans fit protest. But if dem still sign beta striker like Victor Osimhen, this one go just be backup wey sabi small ball.
E Go Fit Run Mentorship?
One sweet angle be say, Calvert-Lewin fit help mentor young ballers like Hojlund and Joshua Zirkzee (if e no carry load go another club). At least, e get Premier League experience, and if na few minutes e dey play, maybe e body no go scatter again.
Bottom Line?
United dey plan one coded move. Free striker wey no go vex if e dey bench? Maybe. But fans go still open eye dey watch this one like VAR.