Monday, July 14, 2025
HomeManchester UnitedRashford Fit Japa from Man United – Club Don Plan Talk with...

Rashford Fit Japa from Man United – Club Don Plan Talk with Am!

Wahala dey cook for Old Trafford as fresh report don drop say Marcus Rashford and Manchester United go soon siddon reason im future.

Dem talk say Man United don plan serious meeting with Rashford as dem dey look whether the guy go waka comot from the club this summer.

United really dey find money anyhow, especially as dem no qualify for Europe for 2024/25 season. Na why dem dey even reason say make some players comot, so dem fit raise funds.

Sir Jim Ratcliffe, wey be co-owner, don already bring in plenty cost-cutting measures wey no too sweet fans belle. Now everybody dey fear say new coach Ruben Amorim no go even see better budget to rebuild im squad.

Yes, dem don sign Matheus Cunha from Wolves, and one small defender Diego Leon from Cerro Porteno. But bros, if nobody comot, new players no go too enter. Money tight!

Rashford No Dey Amorim Plan – Talk Don Set

Report wey come from transfer baddie Fabrizio Romano talk say Rashford don already gree say him no dey Ruben Amorim’s plan.

Rashford

Dem say United go talk with am next week, and Rashford sef don reason say e fit better make him find new club.

Make we no forget say United bin loan am go Aston Villa for January, so na from there people begin dey reason say im future no sure again.

Who Wan Sign Rashford Now?

Aston Villa fit still get interest, but dem no gree pay the £40 million buy clause wey dey inside the loan deal. Reason?

Villa dey face financial gbege on top their own head, and Rashford salary na mad package – e dey earn more than £300,000 per week.

That kain wage be like wetin dey chase clubs away.

Barcelona sef dey show small interest, especially now wey Nico Williams don sign new contract with Athletic Bilbao reach 2035. E mean say Barca go need another winger, and Rashford name dey the list.

But wahala still dey – Barca pocket dey dry too! Dem no sure say dem go fit pay Rashford salary unless the guy gree cut him pay small.

And even if e reach Barca, e fit no be guaranteed starter o! Make we reason say Barca still get:

Robert Lewandowski Lamine Yamal Raphinha

So Rashford fit just dey bench dey look ball dey pass am. And with World Cup 2026 dey near, bros need where e go dey play steady if e wan get England call-up.

TPB Talk Zone

You feel say Rashford suppose cut salary go Barca?

Or e better make am just go Villa go enjoy football life steady?

Drop your take below – TPB dey hear you!

Praiz
Praizhttps://thepidginblog.com
Ogbonge news writer.
RELATED ARTICLES
Subscribe
Notify of
guest
0 Comments
Oldest
Newest Most Voted
Inline Feedbacks
View all comments

Most Popular

Recent Comments

0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x
Skip to toolbar