Monday, September 1, 2025
HomeArsenalNo Fee Agreed: Arsenal Move for ‘Incredible’ Star Don Jam Brick Wall

No Fee Agreed: Arsenal Move for ‘Incredible’ Star Don Jam Brick Wall

Arsenal move to sign Valencia defender Cristhian Mosquera don enter one kain wahala as dem no fit agree on transfer fee, na wetin journalist Alan Smith yan.

The Spanish centre-back wey be just 21 years old dey eye summer waka go Emirates sharply, and him don already settle personal terms with Arsenal. But na the two clubs still dey drag matter — no solid progress from their talks so far.

Arsenal target

Valencia dey para say Arsenal wan run cheap. Dem dey expect make Arsenal drop over £20 million, but Gunners first bid na around £12 million, wey Valencia sharply bounce like bad cheque.

Even though Mosquera na enter last year of him contract, Valencia still offer am extension because plenty clubs across Europe dey eye the guy. At first, e be like say e go remain for Mestalla, but once Arsenal interest enter the matter, the guy head don turn.

Reports talk say Mosquera don already tell Valencia say e go prefer link up with Mikel Arteta for London this summer. RB Leipzig sef dey among the clubs wey dey follow am look.

Arsenal dey see Mosquera as “the perfect backup” to William Saliba, but if dem serious, dem go need increase the money wey dem dey offer. Valencia no dey smile — dem want better value pass wetin Arsenal first drop.

Meanwhile, Arsenal own summer moves don dey gather steam. Dem don announce two fresh signings:

Former Chelsea keeper Kepa Arrizabalaga, Ex-Real Sociedad midfield general Martin Zubimendi.

No be only that — dem still dey final stage to sign Christian Norgaard from Brentford, and talk don reach advanced level with Sporting Lisbon striker Viktor Gyokeres.

Word be say Arsenal don already lock down Gyokeres on a 5-year deal worth around £200k per week, and the Sweden striker dey now push make the move quick happen before transfer window close.

Praiz
Praizhttps://thepidginblog.com
Ogbonge news writer.
RELATED ARTICLES
Subscribe
Notify of
guest
0 Comments
Oldest
Newest Most Voted
Inline Feedbacks
View all comments

Most Popular

Recent Comments

0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x
Skip to toolbar