Tuesday, September 2, 2025
HomeArsenalNoni Madueke: Arsenal Don Reach Agreement With Chelsea to Sign £52m Baller

Noni Madueke: Arsenal Don Reach Agreement With Chelsea to Sign £52m Baller

Gunners dey close to land their fourth signing for dis summer transfer window.

Deal don set: Noni Madueke dey prepare to waka go Arsenal from their London rival Chelsea.

Arsenal don finally strike correct agreement with Chelsea to sign Noni Madueke.

TPB hear say di deal na around £52 million, and some reports even yan say im medical go soon happen.

Di 23-year-old baller go sign five-year contract as im dey ready to cross from west London enter north London.

Madueke

Even though Noni play key role for Chelsea last season wey help dem qualify for Champions League and win Conference League, competition for di attack don increase wella — especially now wey Joao Pedro and Jamie Gittens don join.

Last week, after Chelsea knack Palmeiras to enter Club World Cup semi-final, head coach Enzo Maresca come talk him mind about di tori wey dey fly say Madueke fit commot.

Enzo talk say:

“Noni don really dey important for us dis season. Even today again, e show him importance.

But wetin I dey always talk be say I want players wey really wan stay and happy to dey with us.

Anybody wey no dey happy, make dem free go.

No be just Noni, na di same for all di players wey we get.

But again, Noni don give us better season and today self e show him class.

Noni, wey be England international, go now become Arsenal’s fourth signing for dis their busy summer transfer window — after dem don already sign Christian Norgaard, Martin Zubimendi, and him former Chelsea teammate Kepa Arrizabalaga.

Praiz
Praizhttps://thepidginblog.com
Ogbonge news writer.
RELATED ARTICLES
Subscribe
Notify of
guest
0 Comments
Oldest
Newest Most Voted
Inline Feedbacks
View all comments

Most Popular

Recent Comments

0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x
Skip to toolbar