Marcus Rashford, Manchester United forward, don dey Barcelona as e wan finalise hin season-long loan move go Camp Nou. Di 27-year-old don finally dey close to settle hin short-term – and maybe long-term – future as Barcelona don agree deal to carry am for di 2025/26 season with option to buy.
Reports dey talk say Barca fit activate one £26 million clause to make di move permanent by next summer. Rashford don even gree collect 15% pay cut to waka commot from Old Trafford again. But even with di cut, e go still dey collect £12.1 million yearly salary as e dey join up with Lamine Yamal, Raphinha and Lewandowski for attack.
Video Show Rashford for Barcelona, Fans Welcome Am
Rashford touch down for Spain on Sunday evening and video don show am inside one car for Barcelona. As one fan hail am, Rashford smile and give thumbs-up. Another person ask am if e happy to make di move, but di video cut off before we hear hin response.

Another video wey Fabrizio Romano drop show Rashford as e dey waka pass Barcelona airport with hin people. Dem protect am small, before dem sharply waka commot from camera view.
Medical Next, Pre-Season Next Stop
Di Man United academy product go soon do hin medical with Barcelona. If everything go well, dem go carry am join pre-season tour for Asia dis same month.
Barca go play their first friendly match of di summer against Vissel Kobe on July 27. After dat, dem go face FC Seoul and Daegu FC for South Korea. Rashford fit make hin debut for any of these matches if dem fit register am in time.
Rashford Time with Man United
If Rashford make di move permanent by next year, e go end hin journey with Manchester United wey start since hin small pikin days. Di England forward don play 426 matches for di Red Devils, score 138 goals and give 77 assists for all competitions.
Even last season, Rashford still deliver for Aston Villa on loan, as e score 4 goals and get 6 assists in 17 appearances. But Villa no gree pay di £40m wey Man United dey ask to sign am permanently.
English Players and Barcelona – E No Too Common
When you reason English players for Spain, na usually Real Madrid wey come mind – dem don carry players like David Beckham, Michael Owen, Jude Bellingham, Steve McManaman and Jonathan Woodgate.
But for Barcelona side, e rare to see Englishman wear dem jersey. In fact, Gary Lineker na di last one wey do am – and dat one happen for late 1980s. Lineker score 51 goals in 138 games for Barca. Since then, no other Englishman don shine like dat for La Blaugrana.
Even for youth level, na Louie Barry from Aston Villa academy wey join La Masia for 2019, but him no ever play senior match for di main team.