Thursday, August 21, 2025
HomeBarcelonaBarcelona don sign Marcus Rashford from Man United: Full gist, possible debut...

Barcelona don sign Marcus Rashford from Man United: Full gist, possible debut date & permanent buy clause dey involved

Barcelona don confirm say Marcus Rashford don join dem on loan from Manchester United, and the England baller go spend the 2025-26 season for Camp Nou, with option to sign am permanently if tins go well.

Last season, Rashford bin dey on loan for Aston Villa, and dem coach Unai Emery bin get chance to buy am for £40m this summer. But Villa say dem no wan commit long-term, so na why many tori start fly about wetin go happen to the 27-year-old future.

But as e be, Rashford dream club na Barcelona, and now e don finally reach Camp Nou.

“FC Barcelona and Manchester United don reach agreement to loan Marcus Rashford until 30 June 2026. The deal still get option to buy di English forward,” na wetin Barcelona yan for official statement.

“Di player don sign contract as Barça baller dis afternoon for private meeting wey include club president Joan Laporta, Football Area director and other board members.”

Rashford don land officially for Barca – na loan dem do am first

Man United self don confirm say di deal don happen.

“Marcus Rashford, Manchester United forward, don join Barcelona on loan for di full 2025/26 season,” na wetin United talk.

“Since 2016 wey e debut for Man U, Rashford don play 426 matches, score 138 goals and win five big trophies.

https://x.com/FCBarcelona/status/1948069832584311086?ref_src=twsrc%5Etfw%7Ctwcamp%5Etweetembed%7Ctwterm%5E1948069832584311086%7Ctwgr%5Eb3cdfc3926e8fab25e40d41fbc5f0d350453872c%7Ctwcon%5Es1_c10&ref_url=https%3A%2F%2Fwww.sportsmole.co.uk%2Ffootball%2Fman-utd%2Ftransfer-talk%2Fnews%2Fall-the-details-as-barcelona-confirm-blockbuster-deal-for-man-united-forward-rashford_577851.html

Now, e don move go Spain to join Barcelona for temporary spell. Everybody for Manchester United dey wish am beta luck for di season.”

Barca fit still sign am permanently by next summer

Transfer ogbonge insider Fabrizio Romano talk say Rashford go collect €14m (£12.1m) gross salary for di year wey e go spend for Barcelona, plus bonus based on how many match e go play.

Reports talk say Rashford gree collect 15% pay cut just to make di deal happen. Man United no dey pay any part of di salary again, so dem benefit wella from di move even though dem no sell am.

This go remove about £300,000 per week from Man United wage list, and if Barcelona wan sign am permanently next summer, dem go pay €30m (£26m).

Last season for Villa, Rashford score 4 goals and give 6 assists in just 17 games.

E fit debut for Barcelona against Japanese side Vissel Kobe on July 27 as part of Barca preseason tour for Asia.

Praiz
Praizhttps://thepidginblog.com
Ogbonge news writer.
RELATED ARTICLES
Subscribe
Notify of
guest
0 Comments
Oldest
Newest Most Voted
Inline Feedbacks
View all comments

Most Popular

Recent Comments

0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x
Skip to toolbar