Friday, January 16, 2026
HomeReal MadridReal Madrid Transfer Tori: One Big Young Star Don Comot From Club

Real Madrid Transfer Tori: One Big Young Star Don Comot From Club

Chema Andres don officially comot from Real Madrid as di 20-year-old midfielder don complete €6m (£5.1m) move go Bundesliga club Stuttgart.

Di Real Madrid academy pikin (Castilla product) use social media tell fans bye-bye on Saturday, as e don end seven years journey for Santiago Bernabeu.

Andres, wey people dey see as one of di most promising talents for Madrid academy, na one player wey di new manager Xabi Alonso like well well. E even play under am for Club World Cup. For di deal, Madrid include one buy-back clause, so dem fit buy am back later if e perform well for Germany.

Real Madrid

After seven years, time don reach to say goodbye to wetin be my home and life for all dis time.

I come as small pikin wey wan learn and play ball, now I dey go as different person — full of memories, lessons and people wey shape my journey.

Thank you for everything. I go always carry dis club for my heart,” — na wetin Andres write.

Real Madrid Still Dey Monitor Chema Andres

Even though La Liga clubs bin send offer, Andres choose permanent transfer go abroad. Reports say Madrid sef prefer am like dat, since most of di Spanish clubs only wan collect am on loan.

According to Marca, both di Madrid board and Alonso believe say Bundesliga go help am grow better, with more first team chance and top-level experience. If e shine for Stuttgart, e fit return back to Madrid in future.

Madrid

For di 2025–26 season, Andres go play Bundesliga, Europa League and DFB-Pokal. Before season start, Stuttgart go face Bayern Munich for German Supercup on 16 August.

Who Be Chema Andres?

Chema Andres wey full name na Jose Maria Andres Baixauli, na Valencia boy wey born 25 April 2005. Na from Real Madrid academy e rise, from Infantil A reach Castilla (di B team).

Over di years, e become one of di most important talents of e generation — people dey praise am for maturity and tactical discipline.

Andres help Real Madrid Juvenil win Copa del Rey Juvenil for 2023, wey boost e rep as correct prospect. E play three times for Madrid first team and follow Spain win di UEFA European Under-19 Championship for 2024.

Dem dey always compare am to Sergio Busquets and Rodri. People dey hail am for tactical intelligence, vision, and how e sabi control game tempo. E vertical passes and calmness for midfield dey make scouts from all over Europe dey watch am. E fit turn superstar soon.

Praiz
Praizhttps://thepidginblog.com
Ogbonge news writer.
RELATED ARTICLES

1 COMMENT

  1. Практичный маркетплейс https://akki-store.com приветствует вас в нашем разделе цифровых товаров для FB. Если вам нужно купить аккаунты Facebook, чаще всего важен не «одном логине», а в качестве фарма: уверенный спенд, наличие пройденного ЗРД в кабинете и правильно созданные ФП. Мы подготовили короткую карту выбора, чтобы вы без лишних вопросов понимали что подойдет под ваши офферы до оплаты.Что внутри: что вы покупаете на практике. Важно: покупка — это только вход. Дальше решает подход к запуску: какой прокси используется, как вы передаете лички без триггеров, как проходите чеки и как масштабируете адсеты. Гордость нашего сервиса — это наличии масштабной базы знаний по FB, где выложены практичные инструкции по работе с БМами. Здесь доступны страницы Meta для разных сетапов: от дешевых авторегов и заканчивая трастовыми БМами с высоким лимитом. Оформляя у нас, клиент получает не только валидный профиль, но и оперативную помощь саппорта, прозрачные правила чека, страховку на валид и максимально конкурентные цены среди селлеров. Важно: действуйте в рамках закона и всегда с учетом правил Meta.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

Most Popular

Recent Comments

Skip to toolbar