Thursday, August 21, 2025
HomeManchester UnitedOPINION: Carlos Baleba Go Fit Help Man U?

OPINION: Carlos Baleba Go Fit Help Man U?

Manchester United don reportedly reach out to Brighton & Hove Albion through middlemen to show say dem wan sign Carlos Baleba for this summer transfer window.

The Red Devils dey close to secure Benjamin Sesko from RB Leipzig, and di Slovenia international go be di third major player wey dem go sign for this current market.

Carlos BALEBA

But midfield still remain one area wey di club dey look to strengthen this summer, especially as head coach Ruben Amorim don talk during pre-season say di team still get weak point for middle of park.

Baleba show better form for Brighton for di 2024-25 season. Di 21-year-old deliver back-to-back solid performances, and na why big clubs dey eye am now.

Man United Dey Eye Baleba As Dem Next ‘Big Signing’

According to transfer guru David Ornstein, Man United don already contact Brighton through middlemen to ask wetin e go take sign Baleba.

Ornstein talk say Brighton no really wan sell am, and Man United sef know say dem fit no succeed. But even at that, Baleba na dem number one target as Sesko deal don almost complete.

Amorim

Another transfer expert Fabrizio Romano still yarn for the matter. He say Man United don tell make dem dey give update on Baleba own.

Romano still talk say di transfer no go easy because of money matter, as Brighton no wan gree lose di player wey dem sign from Lille for summer 2023.

Baleba don play 77 matches for Brighton, score four goals and give two assists. For di 2024-25 season alone, he get four goals and two assists inside 40 games across all competitions.

Baleba Go Fit Help Man United?

Amorim don boost him attack this summer with Bryan Mbeumo and Matheus Cunha, and Sesko go still join soon to add more fire for front.

But for midfield, Man United still dey short. Dem never get that kind strong, physical presence wey go hold di middle well. Baleba fit change that story for di 20-time English champions.

Baleba na correct defensive midfielder. Him get energy, pace, and sabi carry ball. But na him ball control and passing dey make am stand out. Di Cameroonian sabi play ball wella.

E fit push di team forward because e dey dribble well. Amorim dey find player wey fit handle pressure and move ball well under tight condition — Baleba match that description.

But di wahala be say Brighton tie am for contract reach June 2028, and dem still get option to extend by another year. Because of how good he be, e no go shock anybody if Brighton ask for around £85 million to release am.

Praiz
Praizhttps://thepidginblog.com
Ogbonge news writer.
RELATED ARTICLES
Subscribe
Notify of
guest
0 Comments
Oldest
Newest Most Voted
Inline Feedbacks
View all comments

Most Popular

Recent Comments

0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x
Skip to toolbar