Newcastle don reportedly reach agreement on personal terms with Wolverhampton Wanderers striker Jorgen Strand Larsen as dem dey rush find attacking reinforcement before transfer deadline.
The Magpies dey inside wahala after dia top striker, Alexander Isak, go strike. As e be so, Eddie Howe no get any recognised number nine wey fit lead di line.
Isak don para say Newcastle break promise and he don vow say he no go play again. Newcastle bin reject one big offer from Liverpool for di Swedish striker, but dem still dey hold am tight until dem land beta replacement.
Newcastle dey eye Larsen as option
According to reports from Express and Star, Newcastle don already agree personal terms with Norway international Larsen, but dem never table direct offer give Wolves.

Larsen, wey be 25 years, join Wolves from Celta Vigo last summer on loan, before Wolves sign am permanently this summer for £23m. He score 14 goals inside 35 Premier League games last season.
Even though Larsen no dey push for exit, sources dey talk say e fit wan test himself for Champions League stage. Wolves dey price am around £60m, and that kain demand fit slow down Newcastle move, especially as Wolves coach Vitor Pereira no wan short for strikers.
Liverpool dey monitor as Isak matter dey hot
Liverpool dey standby dey monitor di situation. The Reds still get plenty forwards, but if Isak wahala with Newcastle reach deadlock, Arne Slot fit push for di Swedish hitman.
Meanwhile, new signing Federico Chiesa don already dey shine after scoring against Bournemouth, but adding Isak go still make Liverpool attack look more dangerous.

Newcastle frustration don increase as dem miss out on Joao Pedro, Liam Delap, Hugo Ekitike and Benjamin Sesko – all don move go rival Premier League clubs.
Isak dey isolated from di main squad as he dey wait whether Liverpool go come back with another offer, after dia first £110m bid chop rejection.