Friday, January 16, 2026
HomeLiverpoolLiverpool Drop 22-Man Squad For Champions League – Chiesa Miss Out

Liverpool Drop 22-Man Squad For Champions League – Chiesa Miss Out

Liverpool don release their 22-man squad wey go represent dem for the 2025/26 Champions League league phase. But di big shocker be say Arne Slot no carry one of im senior attackers, Federico Chiesa.

Last season no too sweet for di Reds after PSG knock dem out for round of 16 on penalties. But this season dem dey hope to correct dat mistake.

Domestically, Slot boys dey shine as dem be the only team wey don start Premier League season with 100% record after three matches.

Di Fixtures Wey Dey Wait Liverpool

Liverpool go first face Atletico Madrid for Anfield on September 17, before dem waka go Turkey meet Galatasaray on September 30.

Other games wey dey wait dem:

  • Eintracht Frankfurt – October 22
  • Real Madrid – November 4
  • PSV Eindhoven – November 26
  • Inter Milan – December 9
  • Marseille – January 21
  • Qarabag – January 28

Chiesa Miss Out, Rio Ngumoha Enter

Di biggest gist na say Chiesa no dey di squad. Even though di Euro 2020 winner score volley goal for opening Premier League match against Bournemouth, Arne Slot no carry am for UCL list.

Instead, 17-year-old Rio Ngumoha enter ahead of am. Di small boy go join Salah, Gakpo, Isak and Ekitike for attack.

Because UEFA rules only allow 17 non-homegrown players, Ngumoha take one of di slots even though he too young to count as home-grown. Dis decision don raise plenty eyebrows.

Other Talking Points Inside Di Squad

  • Florian Wirtz, Gravenberch, Mac Allister, Curtis Jones and Szoboszlai dey lead di midfield.
  • Wataru Endo dey listed as defender this time.
  • New boy Giovanni Leoni dey inside too.
  • Stefan Bajcetic, Calvin Ramsay and Rhys Williams no dey List A.
  • Trey Nyoni no dey A list but fit qualify for B list since he be under-21 wey don dey Liverpool for over two years.
  • Freddie Woodman don join as third-choice keeper.

Full Liverpool Champions League Squad

Goalkeepers: Alisson, Mamardashvili, Woodman

Defenders: Gomez, Van Dijk, Konate, Endo, Robertson, Leoni, Bradley, Frimpong, Kerkez

Midfielders: Wirtz, Mac Allister, Szoboszlai, Jones, Gravenberch

Forwards: Salah, Gakpo, Isak, Ekitike, Ngumoha

RELATED ARTICLES

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

Most Popular

Recent Comments

Skip to toolbar