Bayern Munich don dey rush to extend contract of Michael Olise wey dem sign from Crystal Palace for summer 2024.
Di French winger don already turn star man for Germany, after e drop 43 goal contributions in 55 matches last season wey help Bayern collect Bundesliga title back from Bayer Leverkusen.
Olise contract still dey valid till June 2029, but according to report, Bayern wan extend am sharp-sharp so that dem go block clubs wey dey eye di baller. If dem succeed, any future move fit cost over £80m.
Liverpool Eye Am As Salah Replacement
Report talk say Liverpool dey follow Olise matter close-close. Di Reds dey see di 23-year-old as long-term replacement for Mohamed Salah, wey go turn 34 next year. But Liverpool no dey alone – Chelsea still dey chase am, plus talk say Barcelona dey monitor di guy future too.

Recall say Chelsea even trigger im £35m release clause back in 2023, but Olise reject di deal and sign fresh contract for Palace before Bayern carry am with £50m transfer fee.
Olise Rise No Be Small
Olise no dey only show skill, e dey combine pace, creativity and technical sabi. Last season na serious upgrade from im Palace days – from 16 goal contributions in 19 matches for England, e jump reach 43 with Bayern in just one season.

At 23 years old, di guy ceiling still dey very high, and e fit soon dey among di best wingers for Europe.
As e be so, Liverpool and di rest go need wait see whether Bayern go succeed lock am down, or if di market go still open chance for another big-money move.
