Friday, January 16, 2026
HomeChelseaChelsea 'Expecting' Punishment After FA Slam Dem With 74 Charges

Chelsea ‘Expecting’ Punishment After FA Slam Dem With 74 Charges

Chelsea dey ready face wahala as Football Association don slam dem with 74 charges wey relate to payment give agents, intermediaries and third-party deals wey concern players.

FA drop statement Thursday morning, and few minutes later Chelsea release dia own talk. Dem emphasize say na during 2022 takeover process dem self discover wahala, and dem even open up about am.

New owners Todd Boehly and Clearlake Capital point finger go Abramovich era, say na under him regime di breaches happen between 2009 and 2022. Current board no dey linked to di issues.

Wetn FA Fit Do Chelsea?

FA get plenti options of punishment wey dem fit drop. From heavy fine, to transfer ban wey fit last more than one window, even down to points deduction. Demotion from Premier League no dey on table.

According to The Telegraph via TPB, Chelsea dey expect say na serious fine dem go face, instead of punishment wey go scatter Enzo Maresca squad balance. Broadcaster Ben Jacobs still add for X say Chelsea believe dem no gain sporting advantage from di matter.

Meanwhile, di club don hire top accountancy firm make dem review di breaches well. Plus, Premier League sef dey run dem own investigation. Chelsea get until September 19 to submit official response.

Which Transfers Carry Wahala?

Deals wey involve Eden Hazard, Willian and Samuel Eto’o dey among di ones wey break regulation. Most of di issues dey come from business between 2010-11 season and 2015-16 season.

Hazard join from Lille for 2012, while Willian and Eto’o land Stamford Bridge from Anzhi Makhachkala back-to-back inside August 2013.

RELATED ARTICLES

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

Most Popular

Recent Comments

Skip to toolbar