Thursday, August 21, 2025
HomeArsenalArsenal and Chelsea dey drag Star Player – Arteta don hear...

Arsenal and Chelsea dey drag Star Player – Arteta don hear tori say di guy wan comot Leipzig

Arsenal don ready body say Chelsea fit wan enter race to sign Xavi Simons, di forward wey dey plan run from RB Leipzig dis summer.

Dem just sign Noni Madueke from Chelsea for Friday, and di deal fit reach £52 million. But Arteta still dey hungry for attack players. One tori even yarn say dem don near to sign Sporting Lisbon striker, Viktor Gyokeres.

No be shocking move, as Arsenal no too score plenty goals last season. Liverpool nak dem with 17 goals difference.

Football journalist Fabrizio Romano don talk say Arsenal really like Simons. But Chelsea too dey eye di guy.

Xavi Simons go blend for Arsenal?

For Leipzig, Simons dey mostly play from di left wing. But sometimes dem free am make e waka enter center, where e dey sabi create better chances.

Last Bundesliga season, di 22-year-old knack 10 goals and serve 6 assists. Compared to Martinelli, Simons fit give Arsenal more wahala against teams wey dey park bus.

But e get wahala – Madueke fit still play left, and Bukayo Saka don hold right strong. E mean say Simons go fight hard to enter starting XI.

Simons go blend for Chelsea?

Chelsea don already sign attackers like Liam Delap and Joao Pedro dis summer. Dem two fit play striker.

Simons don play false nine before, but to enter that Chelsea frontline no go easy. Jamie Gittens from Dortmund go don join, plus Pedro Neto, Estevao, and Cole Palmer still dey.

If Simons go Chelsea, e go really hustle to collect spot.

Praiz
Praizhttps://thepidginblog.com
Ogbonge news writer.
RELATED ARTICLES
Subscribe
Notify of
guest
0 Comments
Oldest
Newest Most Voted
Inline Feedbacks
View all comments

Most Popular

Recent Comments

0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x
Skip to toolbar