Arsenal don enter beast mode for transfer window as dem close in on the signing of Sporting Lisbon striker Viktor Gyökeres, wey many don label as the perfect replacement for Kai Havertz.
The Gunners, wey narrowly miss Premier League title last season to Liverpool, no wan dull again. And as reports from Fichajes talk, Arsenal don submit £60 million bid to secure the Swedish striker, with a 5-year contract already dey cook behind closed doors.
Havertz Out — Gyökeres In?
Even though Havertz show glimpses of form — 9 goals in 23 league appearances — e still no fully convince fans say him be the long-term solution for that central striker role. Some matches, he go show, but most times, e dey like say he forget say dem dey play ball.
Arsenal fans don vex tire.
Now dem dey look Gyökeres, a man wey bang 45 goals last season for Sporting. Make we no lie, those numbers dey loud pass London generator — and that na the kind of striker wey Arteta need to convert all those crosses and cutbacks wey dey always waste.
Tactical Fit: Why Gyökeres Make Sense for Arsenal

Arteta dey build a squad wey balance attack and defence. While the defence na wall (Arsenal concede just 34 goals — best in the league), their 69 goals scored no too dey loud when compared to title rivals like Liverpool (86 goals).
Gyökeres no just be striker wey dey wait for ball; he sabi press, hold up play, and e dey always dey involved. If Arsenal midfield — led by Ødegaard and maybe Eberechi Eze if the transfer happen — fit feed am ball steady, the guy go deliver fire and brimstone.
Lessons From January Failure
No be news say Arsenal been eye Ollie Watkins in January, but dem slack. Dem no act fast and dem suffer am. Liverpool collect title, and many fans blame the board for failing to add firepower.
This summer? Different energy. Arsenal dey move with speed and precision. If Gyökeres deal go through, e fit be their fourth signing — after Martin Zubimendi, Kepa Arrizabalaga, and Christian Norgaard.
Transfer Talks: Where Dem Stand?
Reports say Arsenal first try with a £52 million offer wey Sporting sharply reject. But now dem ready to match the £60 million price tag, especially as Gyökeres’ release clause no too high compared to his performance.
Fabrizio Romano even confirm say personal terms don already set — na just club-to-club final agreement remain.
What This Means for Arsenal
If Gyökeres enter, Arteta go get fresh options.
Saliba go rest small if dem still bring Mosquera. Midfield go dey balanced with Zubimendi and Norgaard. Attack go deadly with Gyökeres, Saka, Martinelli, and maybe Eze.
And most importantly, Arsenal no go carry last again for title chase.
TPB Verdict:
Arsenal dey set up something serious. If everything align, Gyökeres fit be the missing piece wey go turn their attack to war zone. But one thing dey clear — if Havertz no raise him game, na bench go turn him best friend.
Wetin you think? Shey Gyökeres fit fire Arsenal win the Premier League title?
Drop your thoughts now.