After Arsenal knack AC Milan 1-0 for Singapore pre-season tour, Mikel Arteta don give update on Gabriel Magalhaes and Jurrien Timber injury matter. Saka na the guy wey score di only goal, but fans dey ask, “Where Timber and Gabriel dey?”

Arteta yarn say Timber never return fully to training since him ankle procedure. Gabriel, on the other hand, get one minor wahala again after e don come back from hamstring surgery. Arteta say na to dey manage dem softly to avoid relapse.
Arteta Tok Am Like Dis:
“Jurrien never dey back, him never join training fully. Gabi get small niggle for training, and as e don dey out for long, we no wan rush am back. The pitch and conditions from Spain to UK to Singapore dey change, so we gats play safe.”
Enter Dowman: 15-Year-Old Boy Dey Ball
One small boy wey burst eye na Max Dowman — 15 years old and e already play senior match for Arsenal! Di winger show confidence, quick legs and even score for post-match penalty shootout, though Arsenal lose am 6-5.

Arteta praise am say, “The environment wey these kids dey enter dey make dem confident. If dem feel safe, dem go show skills. But no be say we don plan Premier League debut yet. Dem still dey adjust to senior football level.”
Next Match
Arsenal go face Newcastle United next for same stadium this Sunday. We go see if Gabriel or Timber go return and whether small boys like Dowman go see minutes again.