Arsenal and Manchester United dey drag for Paris Saint-Germain attacker Lee Kang-in, wey fit waka comot from France before transfer window close.
The 24-year-old start im career for Valencia between 2018 and 2021 before e move go Mallorca. Na from dia e blow, wey make PSG carry am for 2023.
The South Korea international don score 13 goals with 11 assists for PSG across 86 matches. Just last week, e even net against Tottenham Hotspur for UEFA Super Cup.
For last Ligue 1 season, Lee knack six goals and six assists for 30 appearances, plus 11 games for Champions League. E still get contract with PSG till 2028, but rumours don dey fly say e fit move this summer.
Arsenal & Man United Dey Drag Am
According to report wey CaughtOffside drop, Man United dey admire Lee wella and dey follow im matter closely. Napoli sef don show interest, but na Arsenal wey don already make first contact with PSG.

Lee dey mainly play from the right wing, but e fit still play as attacking midfielder or false nine. For Man United 3-4-3 setup, e fit slot in as number 10, while for Arsenal 4-3-3, na wing role sure pass.
PSG Go Release Am?
Lee dey valuable for PSG, so unless serious money land, dem no go too rush release am. Transfermarkt value am around €25m (£21.6m), but PSG go surely ask for bigger cash because of wetin e contribute last season.

Man United don sign three attackers already this summer, but Arsenal fit still shock everybody with late move. For now, e be like say the Gunners dey open to add another sharp forward before window shut down.

Лучший магазин https://buyaccountshop.run приветствует вас в своем ассортименте рекламных активов Meta. Если вам нужно купить Facebook-аккаунты, обычно задача не в «одном логине», а в трасте и лимитах: отсутствие вылетов на селфи, зеленые плашки в кабинете и правильно созданные ФП. Мы оформили практичный чек-лист, чтобы вы сразу понимали какой тип аккаунта брать перед покупкой.Быстрый ориентир: начните с категории Фарм (King), а для масштабирования — переходите сразу в профильные позиции: BM 250$. Важно: аккаунт — это инструмент. Дальше решает подход к запуску: какой прокси используется, как вы передаете лички без триггеров, как проходите чеки и как дублируете кампании. Гордость нашего сервиса — это наличие приватной базы знаний по FB, где написаны свежие гайды по запуску рекламы. Здесь вы найдете решения FB под разные задачи: от миксов и заканчивая трастовыми БМами с пройденными запретами. Переходите в сообщество, читайте практичные кейсы по заливу, упрощайте работу с Meta и в итоге улучшайте конверт вместе с нами прямо сейчас. Важно: действуйте в рамках закона и всегда в соответствии с правилами Facebook.