Monday, July 14, 2025
HomeBarcelonaBarca Wan Carry Nico by Force, But Bilbao Say ‘Who You Be?

Barca Wan Carry Nico by Force, But Bilbao Say ‘Who You Be?

Barcelona don enter serious gbege as dem dey try carry Athletic Club baller, Nico Williams, come Camp Nou. But wahala don gas as Athletic Club no wan hear story, dem dey block road well-well and no even dey blink.

Barca sporting director, Deco, don mark Nico as top priority for this transfer window. Him believe say the 22-year-old winger go fit join coach Hansi Flick plan to take over La Liga and chase Real Madrid commot for top.

But as e be so, Athletic dey play rough – dem no gree release their golden boy like say na small pikin dem dey give biscuit. Dem dey offer Nico new contract wey go last till 2027, plus one ogbonge salary increase.

But guess wetin?

Nico sef don tell their board say e get where e heart dey — Barcelona!

Barca Don Reach Agreement With Nico… But Wahala Still Dey

Barca don already settle personal terms with the Spain international. Dem dey ready to dey pay am €12 million per year (around £196k per week) till 2031. Bros go chop life if e reach Camp Nou.

But the real kasala be say:

Barca wan trigger the €58m release clause – but dem wan pay am small small, like payment plan.

Nico williams

Athletic say lai lai.

Dem want the money complete, upfront, no transfer, no negotiation, no story.

“Na full clause or nothing!” — na wetin dem yarn.

Athletic no dey smile, especially as dem relationship with Barcelona no too gel.

Dem dey suspect say Barca dey try bend FFP rules like say na gymnastics.

Tension dey rise — Days ahead go red hot

As e be so, both clubs dey stubborn.

  • Barcelona: “We wan buy am. But we go pay small small.”
  • Athletic: “If you no get full money, carry your wahala go.”

And as the transfer window dey speed go, e be like say na this coming week go decide everything.

Meanwhile…

Other Clubs Dey Look — But Nico Head Still Dey Camp Nou

  • Arsenal bin show interest, but once dem hear say Nico want £196k per week, dem sharply say “abeg no vex.”
  • Bayern Munich dey watch from far, ready to swoop if Barca fumble.
  • But bros don already make up him mind — na Barca e want.

And if Barcelona flop or delay too much, Nico fit just sign that sweet contract extension with Athletic. Dem don keep the offer for table, dey wait make the matter scatter.

Wetin Deco Talk?

Barca director Deco no even hide mouth.

Yes, Nico Williams wan come,” he talk boldly.

We go try make am happen. The guy dey show say e wan join, and if the conditions dey right, we go do am.

But he still yarn caution:

To sign player, we dey follow steps. This one get release clause. Na how we go make am work remain.”

TPB Final Take:

This one na real La Liga heavyweight title fight off the pitch. Barca dey chase dream, but Athletic dey form area boy. Na who go blink first?

Stay tuned, make we see whether Barca go drop the full bag or Nico go chop the Bilbao millions .

#TPBTransferWatch

Praiz
Praizhttps://thepidginblog.com
Ogbonge news writer.
RELATED ARTICLES

1 COMMENT

Subscribe
Notify of
guest
1 Comment
Oldest
Newest Most Voted
Inline Feedbacks
View all comments
Jide
12 days ago

Lmao…broke Barca

Most Popular

Recent Comments

1
0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x
Skip to toolbar