Date: Sunday, August 3
Venue: Atlanta, Georgia
Competition: Premier League Summer Series
Both Teams Still Get Hope!
Bournemouth and West Ham still dey eye di trophy for dis 2025 Premier League Summer Series, but dem go need more than just win to carry am. Both teams get 3 points after 2 matches – just 3 behind table leaders Man United wey go face Everton same day.
Bournemouth: Hot Start, Man U Blow
Andoni Iraola boys don already play 3 pre-season games – beat Hibernian 2-1, tear Everton 3-0, but chop 4-1 loss from Man United last match.

For dem to win dis Summer Series, dem gats beat West Ham and pray make Everton beat Man United, plus dem goal difference gats clear Man U own.
New signings like Djordje Petrovic and Adrien Truffert fit feature, but Illia Zabarnyi go miss as PSG dey push to sign am.
West Ham: Potter’s Boys Dey Build Momentum
West Ham start pre-season by beating Zurich 3-1, then lose 2-1 to Man U, before bouncing back with 2-1 win over Everton.
Just like Bournemouth, na win + Everton favour dem need. Coach Graham Potter dey use dis tournament to gel him squad ahead of their Premier League opener vs Sunderland.

New signings Jean-Clair Todibo, El Hadji Malick Diouf, and Kyle Walker-Peters fit start. Mohammed Kudus don move go Spurs, so eyes dey on Paqueta, Bowen, and Fullkrug to deliver goals.
Possible Lineups
Bournemouth XI:
Petrovic; Hill, Mepham, Senesi, Truffert; Billing, Soler, Adams; Semenyo, Evanilson, Brooks
West Ham XI:
Areola; Walker-Peters, Mavropanos, Todibo, Kilman, Diouf; Ward-Prowse, Soucek, Paqueta; Bowen, Fullkrug
TPB Prediction: Bournemouth 1-1 West Ham
Both teams go try hard, but with pressure to win, we dey see one close match wey go end in draw. Di goals go scarce – maybe one apiece for Semenyo and Paqueta.
Who You Dey Support?
This Summer Series dey hot, and TPB go run all di latest football tori in full Pidgin!
Na here we dey: www.thepidginblog.com