Monday, July 14, 2025
HomeArsenalBREAKING: Arsenal Don Sign Chelsea Keeper for £5M

BREAKING: Arsenal Don Sign Chelsea Keeper for £5M

Arsenal don complete £5 million move to sign Chelsea goalkeeper Kepa Arrizabalaga as dem sharply trigger hin release clause wey dey hin contract.

The same Kepa wey Chelsea use £71.8 million carry from Athletic Club for 2018 (record fee that year), don now waka go Arsenal for just £5M. Omo, e be like person wey buy iPhone for 1.2M and sell am later for 70k.

Last season, Kepa no even dey Stamford Bridge. E spend am for loan with Real Madrid, before that na Bournemouth e go. Now, e go come back London, but na Emirates direction e dey head this time.

✍️ E don sign 3-year contract with Arsenal and go compete with David Raya for that No.1 spot.

Neto wey been dey do stand-in for Arsenal don return Bournemouth, so Kepa go fill that shoe now.

Kepa.
Kepa don complete his move to Arsenal.

Kepa Talk Say:

I really happy say I dey here. I dey excited and I dey look forward to wetin dey come.

The ambition wey I see for this club, the kind way Mikel Arteta and coach Inaki show me their hunger to win… e make me believe say we dey close to something big.

Hopefully, all of us go achieve am together.

Translation: Oga just talk say Arsenal dey hungry to win, and e wan follow chop that glory too

Arsenal Sporting Director, Andrea Berta Talk Say:

We dey very excited to welcome Kepa to our Arsenal family.

The guy get serious experience. E don win trophies. E sabi wetin e dey do.

And e dey come with that ‘I must win’ mindset. We dey look forward make e meet players and staff. E go blend well.

Arteta sef no calm:

We dey very happy say Kepa dey join us. We don face am before so we know say e get level.

E go bring experience, and the hunger to win dey there. E go boost our levels.

Plus, e know some of hin teammates already so e go fit blend sharp-sharp.

Summary Gist:

Kepa → Arsenal for £5M From £71.8M world-record buy to just £5M… Chelsea fans dey feel am. Last season → loan to Real Madrid 35 starts for Bournemouth Go now compete with David Raya for No.1.

 

Kepa don tell Chelsea bye bye.

Zubimendi and Norgaard fit follow enter Arsenal soon.

Praiz
Praizhttps://thepidginblog.com
Ogbonge news writer.
RELATED ARTICLES
Subscribe
Notify of
guest
0 Comments
Oldest
Newest Most Voted
Inline Feedbacks
View all comments

Most Popular

Recent Comments

0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x
Skip to toolbar