E don happen! Álvaro Carreras, di Spanish left-back wey dey tear pitch up and down, don finally sign for Real Madrid. Dis na serious done deal wey don cause shake for football world, especially as Madrid dey try build beta team for di new season under Xabi Alonso.
Make I yan you everything wey dey ground about di transfer – who be Carreras, why Madrid want am, how di deal happen, and wetin we fit expect.
Carreras na 22-year-old left-back wey come from Spain. E born for Ferrol on 23rd March 2003. Di guy get height (about 1.87m), dey tall, strong, and sabi defend and attack well from left-back.
E start him football journey for Spain with Racing de Ferrol, later move to Deportivo La Coruña, then enter Real Madrid academy when e still small. But na Manchester United come carry am go England when e be teenager.
For United, Carreras no really break into first team, so dem begin send am on loan go different clubs. E play for Preston North End for Championship, then Granada for Spain, and last last land for Benfica for Portugal.
Na for Benfica wey Carreras finally shine. For di 2024/25 season, e become one of di best left-backs for Portuguese league. E play like 32 matches, score 3 goals and even make assists. Him defensive work dey solid, and him attacking runs dey give wahala to opponents. Na dat form make Real Madrid start dey reason am seriously.
Madrid need left-back badly. Ever since Marcelo comot, dem never get person wey go hold dat wing steady. Ferland Mendy and Fran García try, but dem no really hit world-class level consistently. So Xabi Alonso – wey be new coach for Madrid – dey look for strong, young, technical player wey go fit hold left-back for years to come.
Carreras fit play ball. Him fit overlap, cross, and still recover to defend. E get stamina, sabi dribble small, and e strong for air. Xabi Alonso like players wey sabi use ball well, and Carreras fit fit into that system.
Benfica no wan sell Carreras easily. Dem tie am down with €50 million release clause for him contract. But Madrid start talk with Carreras agent and later enter full negotiation with Benfica.
Dem first try look way to reduce di price. One report talk say Madrid even try make Manchester United use buy-back clause wey dem get, then sell give Madrid cheaper. But FIFA no gree because dem no dey allow “bridge transfer” within short time.
At last, Madrid agree pay close to €45 million. Di money no go complete once – dem go pay in installments. Na better move, because Real Madrid fit still balance financial books well.
Reports talk say Madrid go pay like €22.5 million first, then balance di rest plus some add-ons later. Personal terms with Carreras don already dey set since May – him dey ready join di Galacticos.
Dem dey plan make Carreras do him medical for Madrid any moment from now. E no play again for Benfica since June, especially as Club World Cup finish. As I dey write, everything don dey in place for official announcement.
Madrid fit unveil am next week with jersey and press conference. E go join preseason training soon as medical and paperwork complete.

Madrid don get their man. Álvaro Carreras na young baller wey go add fire and ginger to their defense. If e settle quick, fans go fall in love with am. Left side go dey balanced now with Carreras dey maraud up and down. Another big move for Madrid, and another Spanish star don land
TPB Dey here to yarn you update for football..