Fresh transfer update don show say Chelsea don carry strong head for their midfielder Lesley Ugochukwu matter.
The 21-year-old wey dem sign from Rennes for about £23 million back in 2023 no too enjoy better run for Stamford Bridge because of injuries. Even though dem bin see am as one player wey fit grow enter first team, injury scatter everything.
Na why dem kukuma loan am go Southampton for 2024/25 season. Even though Southampton don relegate, Lesley still show himself well – 26 matches for Premier League no be beans!
Chelsea No Wan Hear “Loan” Again – Dem Ready to Sell Am!
Transfer guru Fabrizio Romano don yarn say Chelsea no dey entertain any loan offer again for Ugochukwu.

Valencia and some Premier League clubs bin dey eye am for another loan move, but Chelsea don block that side.
Dem dey reason say since dem pay better money for am two years ago, dem go like recoup as much of that money as possible now through a proper sale.
E still never clear whether any club go gree pay Chelsea’s undisclosed price, but we sabi say Chelsea need to sell some players to meet UEFA financial fair play rules after their recent wahala.
Dem fit still gree do loan if the loan come with “option to buy” clause next summer.
Where Ugochukwu Dey for Midfield List? Far Down O!
Make we talk am as e be — Ugochukwu no dey even near the first 5 midfield options under new coach Enzo Maresca.
Check the lineup:
Moises Caicedo
Romeo Lavia
Enzo Fernandez
Andrey Santos
Dario Essugo
Even players like Reece James and Kiernan Dewsbury-Hall fit slot in midfield if wahala dey.

So as e be, Chelsea no get plan for Lesley again – the club dey ready cash out, and anybody wey wan carry am go need bring serious offer come table.
TPB Yarn Zone
You feel say Chelsea dey rush sell Ugochukwu?
Or you agree say dem midfield don choke, so make dem free am?
Abi make am run go club wey go use am steady?
Drop your comment, TPB dey wait make we hear your mind!