Monday, July 14, 2025
HomeLiverpoolLiverpool Fans Curse don spoil oo -Madrid Use Juventus Chop 1-0 for...

Liverpool Fans Curse don spoil oo -Madrid Use Juventus Chop 1-0 for Club World Cup

Liverpool yanga no work today o, Trent ball wella, Real Madrid   continue to Dey light up Club World Cup

Wetin happen today for Miami na better football show wey sweet fans belle. Real Madrid jam Juventus for Club World Cup round of 16, and na Trent Alexander-Arnold steal spotlight as e drop him first assist for the club. Match end 1-0 and that one goal na wetin carry Madrid enter quarter-final.

First half begin with Juventus pressing like say dem wan carry trophy go house today. Kolo Muani almost score early, lob the ball over Courtois but the ball fly just above bar. Madrid come begin find rhythm small small, with Valverde and Güler trying to settle play.

Trent don Arrive 

But make we talk true, everybody dey wait to see wetin Trent go do. Since he join Madrid this summer, e never really show him magic, but today, na different story. Inside second half, around 54th minute, Trent collect ball for right wing, look up and deliver one sweet-as-sugar cross wey land for the head of young baller Gonzalo García. Boom! Goal! The kind header wey Gonzalo use finish am no be small. That goal na im third for the tournament, but the assist from Trent na wetin scatter internet.

People wey been dey drag Trent say e no sabi defend, today dem calm down small. Even though him still get one or two lapses for back, the way e tear that pass show say him foot still hot. E dey show say for Madrid, e fit focus on him strength — attacking and delivery.

After the goal, Madrid come hold game steady. Juventus still try push back, but Courtois dey alert for post. Bellingham nearly score too, but Juventus keeper deny am. Madrid coach, Xabi Alonso, organize the team well with better game plan. E play 3-4-3 formation wey give Trent enough space to fly wing dey deliver crosses yafun yafun.

As Madrid hold the lead, crowd begin hail players. Kylian Mbappé enter around 68th minute to loud ovation, as e play him first match for the tournament. Even though e no do plenty, fans happy say him don show face. Luka Modrić also enter later, and the fans take am like send-off as e near retirement. You fit feel say the team dey united and everything dey click.

After the final whistle, Trent get plenty praise. E no easy to come into a new team and deliver for big game like this. Social media don dey buzz with clips of that assist, and fans don dey call am “Madrid’s new magic man.”

Real Madrid go now face the winner between Borussia Dortmund and Monterrey for the quarter-final, and from wetin we see today, this team dey hungry for that Club World Cup title. Trent, Gonzalo, Bellingham, Valverde — all of dem dey cook well well.

Juventus go look back and know say dem miss chances wey dem suppose put for net. But for today, na Madrid carry the shine. For Trent, this na new beginning. From Liverpool blood to Madrid engine room, the guy dey make him mark already.

TPB Final thoughts

If you miss the game, just know say e sweet die. Madrid fans dey happy say dem new man don finally show him stuff, and with this kind form, more goals and assists go still land. Make we dey look!

RELATED ARTICLES
Subscribe
Notify of
guest
0 Comments
Oldest
Newest Most Voted
Inline Feedbacks
View all comments

Most Popular

Recent Comments

0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x
Skip to toolbar