Thursday, August 21, 2025
HomeArsenalMan United 0-1 Arsenal: Gunners waka commot Old Trafford with 3 points

Man United 0-1 Arsenal: Gunners waka commot Old Trafford with 3 points

Na new Premier League season kick-off, but na Arsenal first show face for scoreline as dem knack Man United 1-0 for Old Trafford.

Gunners no even stress – one set-piece na im change everything. United fans go dey reason say, “so na so we wan start season?”

How di match take happen

Just 13 minutes, Riccardo Calafiori rise like ladder nod Declan Rice corner enter net. United keeper Altay Bayindir bin try punch ball, but e punch am like person wey never chop since morning. Calafiori just thank am and nod ball home. 1-0 Arsenal.

United bin dey ginger for first half, Cunha and Mbeumo dey disturb Arsenal backline anyhow. But all dia shots na “almost, nearly, so close.” If goals dey count for vibes, United for win this one.

Second half no get too much drama – Arsenal pack bus small, United dey knock but key no dey open door. Na so Gunners thief the 3 points waka commot.

TPB VERDICT

For United, e no too bad. New boys Mbeumo and Cunha show say dem fit sabi ball – dem even combine well with Sesko. If the front three fit begin turn “near miss” to goals, Red Devils fans fit get small hope say season go beta pass last one.

As for Arsenal, dem fit dey thank Baba God say set-piece dey exist. Defence bin dey shake like NEPA light, but 3 points na 3 points. Arteta no go complain too much, even though him fit dey wonder whether him back four fit survive bigger wahala later.

Highlights

  • 13th min (0-1): Rice corner, Bayindir waka mis-yarn, Calafiori nod am in – Arsenal dey lead.

Man of the Match – David Raya

Forget Calafiori goal, the real hero na Raya. The man save 7 shots, deny Cunha and Mbeumo like say na him get bet slip wey talk say “United no go score.” Raya dey command box like Area Boy wey no wan make anybody pass. Solid performance.

Match Stats

  • Possession: Man United 61% – 39% Arsenal
  • Shots: Man United 22 – 9 Arsenal
  • Shots on Target: Man United 7 – 3 Arsenal
  • Corners: Man United 3 – 4 Arsenal
  • Fouls: Man United 10 – 19 Arsenal

Funny enough, United dominate all stat wey no dey count – possession, shots, vibes. But Arsenal carry the only stat wey matter: goals.

What Next?

United go try bounce back when dem go face Fulham for Craven Cottage. As for Arsenal, dem go host Leeds before dem enter big wahala clash with Liverpool for Anfield. If na set-piece again go save dem that day, only God sabi.

Praiz
Praizhttps://thepidginblog.com
Ogbonge news writer.
RELATED ARTICLES
Subscribe
Notify of
guest
0 Comments
Oldest
Newest Most Voted
Inline Feedbacks
View all comments

Most Popular

Recent Comments

0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x
Skip to toolbar