Manchester United fit land RB Leipzig striker, Benjamin Sesko, for around €70m (£61m) for dis summer transfer window.
Dem Red Devils dey hunt new striker wey go boost dia attack for 2025/26 season. As e be say dem don miss out on Sporting Lisbon forward, Viktor Gyokeres (wey dey near Arsenal move), United don shift eye go Sesko side.
Di 22-year-old striker don score 39 goals and give 8 assists inside 87 matches for Leipzig, and reports dey talk say Arsenal sef bin dey interested before.

But according to German journalist Christian Falk, United head scout Christopher Vivell dey push make dem run di deal. Vivell bin work for Leipzig before, so e get better link for di matter.
Man United go gatz bring offer wey reach €70m (£61m) if dem wan sign am now-now.
“When one door close, another one dey open!”
Na wetin Christian Falk yarn give CaughtOffside:
“As Arsenal don comot for Benjamin Sesko matter, Manchester United don get chance. Dem no dey front row before, but now dem don enter di mix.
“Di key man for here na Christopher Vivell – United head of scouting. E work for Leipzig before and now e dey behind di move. E don dey monitor Sesko since April, and even go watch match between Leipzig and Wolfsburg to observe am again.
“Di striker still dey young – just 22. Leipzig go gree sell if correct offer land. Dem dey reason €70m [£61m] as better price.”
Wetin come happen to other strikers wey United dey eye?
Man United still dey watch Aston Villa striker Ollie Watkins and Chelsea boy Nicolas Jackson. Dem two fit still land for Old Trafford if Sesko deal no click.

Watkins price dey around £60m, while Chelsea don put £100m tag on Jackson. But United fit use Garnacho as swap for Jackson if dem wan negotiate another way.
Di two strikers dey proven for Premier League, but Watkins age (29) fit be wahala for long-term plan. Meanwhile, United dey America now for preseason tour as dem dey prepare for new campaign.