Manchester United captain Bruno Fernandes don open mouth say di club need add “one or two players more” for dia squad before dis summer transfer window close.
Di Red Devils don already boost dia attack as Bryan Mbeumo and Matheus Cunha don land, plus young baller Diego Leon wey come from Cerro Porteno and don already impress for dem US pre-season tour.
Man United win di 2025 Premier League Summer Series with two wins and one draw – dem beat West Ham and Bournemouth, then play 2-2 draw against Everton on Sunday night.
After di Everton match, Fernandes blast di team performance say e too lazy and insist say make dem still sign better players before market close.
Bruno Fernandes: “We Need More Competition For Spot”
Fernandes yarn Sky Sports News: “E dey positive. E good say we dey together to build better bond between players. E don help us develop how we wan dey play and involve di new players.”
“But we no suppose end am like this. We no play well and we just dey lazy. Laziness fit cost you at any time and we gats avoid am.”

“E dey improve small small but e never reach where e suppose be. I no wan throw anybody under bus, but e clear say we need more competition inside squad, more quality make everybody sit up. I think na wetin di club dey try do now. Hopefully, we go fit sign one or two more players.”
Man United Don Ready To Land More Signings
Reports show say Man United don already near deal to sign Benjamin Sesko from RB Leipzig – and dat one go likely be di first of more signings to come.
Di club dey still eye goalkeeper and central midfielder, but nobody know how much remain for transfer budget to finish di deals.

United don reduce wage burden as dem send Marcus Rashford go Barcelona on loan. But Jadon Sancho, Antony, Alejandro Garnacho and Tyrell Malacia still dey under contract for Old Trafford.
If dem fit sell Sancho, Antony and Garnacho, Man United fit cash out like £75m – but as e be now, dem never succeed push dem commot.