Manchester United don ready to table one ‘astronomical’ contract offer for Barcelona midfielder Fermin Lopez this summer, based on new update from Fabrizio Romano.
Even though United dey focus on signing new striker, dem still dey prioritize midfield reinforcement after Christian Eriksen waka comot on free transfer for June end.
Fermin Lopez Fit Be Di Big Midfield Signing
Transfer guru Fabrizio Romano reveal say di Red Devils dey “seriously consider” bring in new midfielder if correct opportunity show. Reports from Spain talk say United dey eye Fermin Lopez and dem don ready better package wey go double him current salary for Camp Nou.

Sport talk say Man United fit even drop over €70m (£61m) to seal di deal before summer window close.
Barcelona No Want Sell, But Big Money Fit Change Tins
Even though Barcelona still want hold Fermin, dem go find am hard to turn down that kain money, especially as di 22-year-old no even get sure starting spot under new coach Hansi Flick.

Chelsea and some Saudi clubs also dey eye am, but na Man United currently dey front for di race.
Di challenge be say United no go play European football this season, but dem dey hope say big salary and regular starting spot go sweeten di deal for Fermin.
Fermin 2024/25 Stats: Why E Go Fit United
- Games Played: 46 (all competitions)
- Goals: 8
- Assists: 10
- La Liga: 6 goals, 5 assists in 28 matches
- Champions League: 1 goal, 4 assists in 11 matches
With him high energy, creativity and eye for goal, Fermin fit become one of di biggest signings this summer if United pull am through. So far, e don rack up 19 goals and 11 assists in 88 appearances for Barcelona first team.
TPB Transfer Talk
Whether na Sesko, Fermin or another baller, TPB go always drop am hot for Pidgin. Stay glued, we dey decode all di football market gbege as e dey happen.
For more correct transfer gist in Pidgin: www.thepidginblog.com