Thursday, August 21, 2025
HomeManchester UnitedMan United Transfer News: Benjamin Sesko Dey Wait For Permission To Fly...

Man United Transfer News: Benjamin Sesko Dey Wait For Permission To Fly Enter UK Ahead Leipzig Move

Manchester United dey optimistic say dem go soon seal deal to sign RB Leipzig striker Benjamin Sesko inside next few days.

Newcastle United sef dey eye di 22-year-old striker, but reports talk say Sesko prefer to join Man United instead.

Fabrizio Romano don talk say Man United dey in direct talks with Leipzig to adjust di fee structure and bonus packages. Dem wan rush complete di deal quick.

Sesko don already agree personal terms with United, and di Slovenia striker go sign five-year contract for Old Trafford.

Sesko Dey Wait To Fly Come UK

Newcastle offer €80m (£69.7m) fixed fee with another €10m (£8.7m) add-ons after dem first bid bin fail.

But Man United propose €75m (£65.2m) fixed fee plus €10m (£8.69m) in bonuses to carry di striker go Old Trafford.

According to Ben Jacobs, United dey confident say dem go sign am. Right now, dem dey negotiate how di payment go take dey structured.

Sesko don already make up him mind say na Man United e wan join. Na just permission e dey wait now to fly come UK.

How Sesko Decision Fit Affect Hojlund Future?

After United miss out on Liam Delap wey join Chelsea and Viktor Gyokeres wey go Arsenal, e be like say di Red Devils go finally land top striker.

Sesko go likely be di first-choice number 9 for Man United, and if e join, e fit mean say Rasmus Hojlund go comot from di club.

According to Manchester Evening News, Hojlund wey come from Atalanta fit leave di 20-time English champions this summer. But di striker still dey talk say e go like stay fight for him spot.

Praiz
Praizhttps://thepidginblog.com
Ogbonge news writer.
RELATED ARTICLES
Subscribe
Notify of
guest
0 Comments
Oldest
Newest Most Voted
Inline Feedbacks
View all comments

Most Popular

Recent Comments

0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x
Skip to toolbar