Monday, July 14, 2025
HomeMatch PreviewsMatch Preview: Spain Women vs Belgium Women – Who Go Carry 3...

Match Preview: Spain Women vs Belgium Women – Who Go Carry 3 Points?

Date: Monday

Venue: Arena Thun

Tournament: UEFA Women’s Euro

Na another hot showdown dey come as World Champions Spain Women go face Belgium Women for their second group match. Spain dey eye another 3 points after dem scatter Portugal 5-0 for first game. But Belgium? Dem dey fight to stay alive after 1-0 loss to Italy.

Spain Women – Form Wey Dey Burn Like Fire

Even though dem be current World Cup holders, Spain still never lift the European Championship before. Their best ever na semi-final run back in 1997.

Spain women vs Belgium Women

But this year fit be their time as dem don already start strong:

5-0 win over Portugal – dem score 4 goals for first half! Esther Gonzalez score 2 Vicky Lopez and Alexia Putellas add theirs Cristina Martin-Prieto come finish work late in the game

Spain don win 9 of their last 10 matches – and dem current dey run 6-match winning streak. If dem beat Belgium and Portugal no beat Italy, dem go qualify for quarter-final sharp!

Belgium Women – Pressure Don Full Ground

Belgium bin wan repeat their quarter-final run from 2022, but Italy pour sand for their garri with that 1-0 loss.

Spain women Vs Belgium Women

Now dem dey under pressure because:

Dem don lose 6 of their last 9 matches Spain don beat dem back-to-back this year: 3-2 in February (dem lose after 2-goal lead) 5-1 in May

If Belgium lose again and Italy pick at least 1 point vs Portugal, dem go commot for the tournament.

Team News – Who Fit Play, Who Fit Miss

Spain:

Alba Redondo still dey struggle with muscle injury – 50/50 chance. Cata Coll dey battle illness – if she no fit start, Adriana Nanclares go continue for goal. Aitana Bonmati don recover from meningitis – she play small last match, but coach fit still keep am for bench.

Belgium:

Coach Gunnarsdottir fit still run back-five setup with: Janssens, Tysiak, Kees, Cayman, Deloose Marie Detruyer fit enter midfield for fresh legs. Star striker Tessa Wullaert go lead attack alone again – na tough task be that against Spain defence.

Possible Lineups

Spain:

Nanclares – Battle, Mendez, Aleixandri, Carmona – Lopez, Guijarro, Putellas – Caldentey, Pina, Gonzalez

Belgium:

Lichtfus – Janssens, Tysiak, Kees, Cayman, Deloose – Detruyer, Vanhaevermaet, Teulings, Eurlings – Wullaert

TPB Prediction: Spain 3-0 Belgium

We no go lie – Spain dey play like champions, and Belgium never show say dem fit handle this kind wahala.

We believe say La Roja go control the match from start finish and qualify for next round early.

TPB Fan Talk:

You feel say Belgium fit shock Spain? Abi na another “goal festival” we go see? Who you feel go shine pass: Gonzalez or Putellas?

Drop your score prediction below!

Praiz
Praizhttps://thepidginblog.com
Ogbonge news writer.
RELATED ARTICLES
Subscribe
Notify of
guest
0 Comments
Oldest
Newest Most Voted
Inline Feedbacks
View all comments

Most Popular

Recent Comments

0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x
Skip to toolbar