Thursday, August 21, 2025
HomeBarcelonaBREAKING: Barcelona, Man United don agree on top Rashford loan move

BREAKING: Barcelona, Man United don agree on top Rashford loan move

Just after tori don fly say Barcelona dey close to sign Marcus Rashford from Manchester United, Sky Sports man wey dem dey call Dharmesh Sheth don drop fresh gist.

Di journalist yarn say tins don really go far between di two clubs as dem don reach broad agreement in principle to carry di 27-year-old forward on loan.

Di arrangement go be loan wey go last till di end of di 2025/26 season, and Barcelona go get di option to buy Rashford permanently if dem want.

Right now, both teams dey try sort di final arrangements – like who go pay how much of hin salary and wetin go happen if Barça no buy am finally for 2026.

Even Fabrizio Romano don confirm di matter. E drop hin famous “Here We Go”, talk say Barcelona dey already plan medicals for Rashford for di coming days.

Barca Rashford

Another journalist, Achraf Ben Ayad, still talk say Barça dey really appreciate Rashford and di dedication wey e show to wan join dem.

Di Man United academy graduate don dey insist on di move to Barça since, so personal terms no go be wahala at all.

Juventus bin dey eye am some days back, but Rashford dream since January na to play for Barça. Dem even try run di move that time but e no click.

Now e be like say everything don set. Di England international dey head to Catalonia this summer to join Hansi Flick and hin new team.

Praiz
Praizhttps://thepidginblog.com
Ogbonge news writer.
RELATED ARTICLES
Subscribe
Notify of
guest
0 Comments
Oldest
Newest Most Voted
Inline Feedbacks
View all comments

Most Popular

Recent Comments

0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x
Skip to toolbar