Monday, July 14, 2025
HomeArsenalTransfer Tori: Benjamin Sesko Don Follow Arsenal – E Mean Say E...

Transfer Tori: Benjamin Sesko Don Follow Arsenal – E Mean Say E Wan Come?

Wahala for who no sabi read social media signs o! Arsenal fans don dey jubilate like say dem win league after dem spy wetin RB Leipzig striker, Benjamin Sesko, just do for Instagram – the guy don follow Arsenal page!

E be like say Mikel Arteta no wan rest this transfer window. Dem say the guy ready to splash £70 million just to carry Sesko enter Emirates. But gobe dey – Sesko dey hala say make dem add release clause for him contract. That one don scatter some people for North London small sha.

But no be only Sesko dey market o. One other baller – Viktor Gyokeres – dey enter the matter. New Arsenal sporting director, Andrea Berta, dey eye the Swedish striker like person wey don see awoof suya. But hin own case na another telenovela – hin and him club, Sporting CP, dey drag like NEPA and light bill over how e wan comot.

“Dem promise to sell am for €70 million,” Gyokeres camp talk. But Sporting dey shout back say “na lie!” Wahala no dey finish.

Instagram Follow = Transfer Greenlight?

Meanwhile, Sesko just drop Instagram follow like say e wan remind Arsenal say, “I still dey o.” Even transfer ogbonge Fabrizio Romano no fit ignore am – e call am “hint”. Normally, Baba Fabrizio dey talk say social media no dey mean anything, but this one catch am off-guard.

Sesko agent, Elvis Basanovic, come yarn small:

“Sesko no dey compete with anybody. Na him vs him every day. We get plan wey sure, media no fit confuse us. The boy no be ordinary striker – na SPECIAL striker!”

TPB Verdict:

If Arteta and co wan lock this deal, make dem no dull. Before another club go use Alaba move collect Sesko for night bus.

One eye on the feed, one hand on the wallet. Transfer drama don start. Make una ready!


Drop your thoughts below – You wan Sesko make enter or Gyokeres make collect the shirt? Let’s talk for comment section

Praiz
Praizhttps://thepidginblog.com
Ogbonge news writer.
RELATED ARTICLES
Subscribe
Notify of
guest
0 Comments
Oldest
Newest Most Voted
Inline Feedbacks
View all comments

Most Popular

Recent Comments

0
Would love your thoughts, please comment.x
()
x
Skip to toolbar