Negotiation between Arsenal and Sporting Lisbon for striker Viktor Gyokeres don enter small gbege as both clubs never agree on everything.
Dem don already reach agreement in principle for transfer wey go cost Arsenal £55.1m to carry di Swedish striker come Emirates this summer.
Di 27-year-old don tear net wella for Portugal – scoring 97 goals in 102 matches since e waka comot from Coventry City go join Sporting in 2023. But just as Arsenal dey happy say di deal don almost complete, one small wahala don show face.
Sporting no wan gree on Arsenal add-on plan
According to Football London, Sporting dey drag leg on top di £8.7m add-ons wey Arsenal wan include. Di problem na di condition wey go trigger those add-ons – Sporting say e no dey realistic enough.

Transfer guru Fabrizio Romano yarn say di deal no scatter, but tension don enter di matter as both sides still dey try settle am. Sporting talk say dem no go sign di deal as e be like this, but Arsenal never shift ground yet.
Even though Gyokeres don already yarn say e wan comot this summer, Sporting still dey hold ground firm. Di striker self don refuse show for pre-season training – e clear say e dey ready to bounce.
Gyokeres go make Arsenal pre-season tour?
Mikel Arteta and di Arsenal squad go travel go Asia on July 19 for their pre-season tour. New signings like Noni Madueke and Cristhian Mosquera go follow body.

But as things dey go slow like this, Gyokeres fit miss di trip, unless Arsenal and Sporting settle sharply.
Dem get big friendly against AC Milan for Singapore on July 23, and if Arsenal no quick finish di paperwork, Gyokeres no go play that match at all.
This fit force Arsenal hand to rush wrap up di deal, as dem go like make di striker blend well with di team before season start. Di Gunners go open their 2025/26 campaign away to Manchester United on August 17.