As Chelsea don waka enter the Club World Cup final, dem no just dey close to another trophy — dem also dey close to collect heavy alert. The whole prize pot for this tournament fit reach $1billion (about £726 million) — and Chelsea don already cash out big.
Joao Pedro Brace + Chelsea vs Fluminense
For the semifinal wey happen for MetLife Stadium on Tuesday, new Chelsea striker Joao Pedro bang two goals as dem wipe Fluminense. That win alone carry £22 million enter Chelsea account.

Now dem dey wait the winner between Paris Saint-Germain and Real Madrid wey go play their own semi-final on Wednesday. The final go happen on Sunday, and Chelsea fit add another £7.5 million if dem lift the trophy.
Full Breakdown: How Club World Cup Prize Money Be
FIFA never officially break down all the money matter by team, but na wetin don leak go like this:
Stage | Prize Money |
---|---|
Group Stage Win | £1.5 million |
Group Stage Draw | £750,000 |
Group Qualification | £5.4 million |
Quarter-Final Reach | £9.5 million |
Semi-Final Reach | £15.2 million |
Final Qualification | £21.8 million |
Trophy Winner Bonus | £7.5 million |
So in total, the maximum one club fit win na about £92 million, even though originally e bin dey close to £97 million before dollar-pound exchange rate change.
Wetin Chelsea Don Already Chop
As Chelsea don reach final:
- Dem play 6 matches
- Win 5
- Lose 1 (against Flamengo for group stage)
As things be, dem don collect around £80 million already. If dem win final for Sunday, the total go rise reach £87.5 million.

Maresca Reaction: “No Be My Money Sha!”
When dem ask Coach Enzo Maresca about the £80 million Chelsea don make from the tournament, e just laugh:
“Na Chelsea make that kind money, no be me. Me I just prepare team. I no dey see the money. We no dey chop am, unfortunately.”
TPB Summary
- Chelsea don chop £80m already from Club World Cup
- Win on Sunday go bring am to £87.5m
- Joao Pedro na hero for semifinal with two goals
- Exchange rate don reduce total maximum money from £97m to £92m
- Maresca say na club dey benefit — “we no dey see the alert!”